Wednesday, November 28, 2012

Messi no go fit catch Mueller just yet!



 
E be like say Gerd Mueller, wey dey play for Germany and Bayern Munich before before, record of 85 goals in one calender year go remain de record for now. Barcelona talk say Lionel Messi no go play in the King’s cup against Alaves.
Everybody dey yan say Messi na Argentina’s best forward of all time and na him go secure World Player of the year again for the fourth time dis coming January. De guy go gats score three goals to equal de Mueller guy wey set record in 1972. Barcelona coach Tito Vilanova on Tuesday talk say, “Messi no dey focus on him own personal record but na de team’s success wey dey matter to am most.” “If na himself him dey tink about, he suppose don tell me say him won play in de Cup.”
Barcelona go play Alaves in last-32 second leg at Nou Camp on Wednesday but dem dey carry 3 goals enter the match so confido go dey. Vilanova no go play de regulars like Messi, Victor Vlades, Andres Iniesta, Xavi and Gerard Pickey abi na Pique.
“We go gats give regular boys some time to cool body, na boys like Thiago wey dey injured all this while I won allow play small,” talk Vilnova. “ E be like say David Villa dey ok, if no problem tomorrow I go field am.”
Since Real Madrid kon loose dis weekend against Real Betis, Barcelona dey 11 points ahead of dem in La Liga at the moment. Na de third defeat for Real Madrid in 13 games.
Vilanova talk say, “I no care wettin other clubs dey do dat na dia own wahala, my mind dey tomorrow’s game kampe.”

No comments:

Post a Comment