Wednesday, November 28, 2012

Oyo, Rivers carry gold for cycling

 
No be small thing on Tuesday for the Eko festiva as team Oyo and Rivers tell Naija say dem no come Lagos con play as dem don pocket a gold each for cycling.
Na the Oyo people first win for dis Eko 2012 and na for 200 mita run when Joke Durogbade run past Juliet wey come from Rivers and Enadogbor from Delta.
For the men 200 mita run, Edward Osim win gold for him state, Rivers while Issa and Mohammed too no carry last as dem try win siliver and bronze for Ogun and Kaduna.
Naija vice president, Namadi Sambo na him open the Eko 2012 festiva for the Teslim Balogun Stadium as him Oga, Jonathan no fit make ham.
Sambo promise say the government go give N15 million to any state wey come first for this festiva.
Second go carry N10 million go house while N5 million don dey ground for any state wey come third.

No comments:

Post a Comment